Omoba just dey learn say de Federal Government don appoint a 405-man panel on the implementation of Vision 2020 and the seven-point agenda of President Umaru Musa Yar’Adua.
Abeg, wetin dis 405 man panel go fit do wey the about 800 National Assembly members no fit do?
On top of that we don already get I think na 12 man Economic team, plus all the 40 ministers and their assistants.
Add also the Finance Ministry, National Budget and Planning Ministry, plus all other echetaram, echetaram big
grammar blowing egg-heads. Omoba just think dis na another opportunity to make the National Cake go round
and settle enough people.
Abeg, make una remember say, Omoba dey here oo!